Saturday 24 September 2016

SOME LAFFABLE WARRI PIGIN PROVERBS

1. Na for old age ashawo dey know the value of
pikin.
2. Woman wey never see problem...
Na im dey
still hold breast run.
3. Woman wey dey find pikin no dey wear pant
sleep.
4. Rat wey follow lizard enter rain, Na later e go
hear am.
5. Na for afternoon dem dey find black goat.
6. Weather hot!! É No mean say fowl go lay
boiled egg.
7. EYE WEY DEY CRY DEY SEE ROAD.
8. Pikin wey him mama back cross water, wey
say him march fish, wetin him mama go march?
9. Small pikin wey dem carry for back no know
say the journey far.
10. Person wey don faint before no be stranger to
death.
11. Person wey chop belle full, no know wetin
hungry man dey see.
12. No be as woman dey close eye enjoy sex she
dey enjoy labour pains.
13. Yansh no get teeth but e dey cut poo.
14. Lizard wey fall from tall iroko tree, if nobody
hail am!! é go hail hims
16. IF GIRL TAKE HUSBAND DO BOYFRIEND, SHE
GO TAKE BOYFRIEND DO HUSBAND.
17. Cockroach wey jam fowl, jam bad luck.
18. Na cricket tell him children say, No matter
how ground strong, Them no go sleep outside.
19. Pikin wey say him mama no fine they use
style call him papa blind man.
20. No be eye wey dem take chop eba dem take
dey share meat.
21. Person wey use Elephant set trap, na him
know wetin he wan Catch.
22. When Breeze Blow Fowl Yash Go Open.
23. STUDENT WEY READ NA HIM SERIOUS,BUT
STUDENT WEY PASS NA HIM KNOW BOOK.
24. Dem no dey tell tortoise say race don start.
25. Dem no dey tell blind man say salt no dey for
food.
26. Before you see monkey, monkey don see you.
27. Thief wey jump fence enter house where
owner dey wait for am, no go jump again.
28. If pikin say he sabi die, him papa sef go tell
am say him sabi bury.
29. Na wetin dey sweet for goat mouth, Na im
dey kill am.
30. If e be like say everybody dey craze" na you
dey craze.
31. Meat wey you dey forbid, no use your teeth
cut am.
32. My thing and our thing no be the same oh.
33. Na happiness dey make prick stand.
34. Na as goat stand for market dem dey price
am.
35. Craze no hard to form, na the trekking be
wahala.
36. Its a small world!! No mean say you fit trek
from Naija go London.
37. No matter how hot your temper be, e no fit
boil beans.
38. Chicken wey run from Borno go Ibadan go still
end up inside pot of soup.
39. Today’s newspaper na tomorrow Suya wrap.
40. Akara and moin moin get the same parent, na
wetin dem pass through make dem different.


By a Facebook user

No comments: